Yes
I dey always dey tell people say
For this town we get three different community
Ekpan, Agbasa, & Okere
Agbasa- If dem hold you say you thief phone,
You dey pay for stabiliser and phone
Okere - If them hold you till day break
Na bottom stairs you dey sleep
But Ekpan - If dem wan give you post
Dem no dey look say you be indigene
Na the kind mark wey dey
Your body dem take dey give you position:
If you get one eye you be vice
If your hand dey seize you be P.R.O
If you get bullet mark you Be D.C
If you waka dey wave you be press
Area I hail oooooo! (Old Warri)
Welcome to Warri where all the Mama's dey vex
F*ck up no dey sawa
She tattoo am for her brezz
Her son dey press
Two kala under her dress
She ready shoot Olokpa if them come her address (Rest)
No be today she don dey see her arrest
Area Mama for the hood you no wan see her vex
Apart from cocaine nothing Mama no dey sell
1999 dem lock Mama throw her inside cell
Dem carry her pass me where I for dey play "Monkey Post"
They almost blast me with slap,
I take off with my Kitto's
The first time I see where dem stab person neck
Na '94 two seconds naso andrew fall
Andrew Mama dey bust cry
Who do am don Run
Full compound dey pack "Egbe The Police" dey come
You suppose know Egbe
That guy matter na dead
Him fit arrest the full area if e enter him head
I no be mumu Aje
I know the area well
Full Agbasa, Igbudu dem know my matter there
Odumu, Sobo, Ejegba we get house for Ekpan
Go Udu, Oruvworun
The hands sound
I no Be mumu Aje
I know the Area well
Warri Crisis '99 I dey there
Marine gate, Iyara
We Get House for Ekpan
Go Ogborikoko
Ask na
The hands sound
Dem butcher my friend hand for "Agbasa Feast"
With old cutlass na so fight take enter Street
Igbo Market men dey run enter people shop
Carry 2 Wrong Set Of Shoes till the feast stop
Police dey shout: "If you move..."
I no fit stop!
Follow me enter Ejegba I enter you top
Our biggest fright na Ekpan Hilux Light for night
Those men no get joy beating na their appetite
I dey ceiling when dem carry all my guys go
Government bangle for the hand let the dice roll
Papa dey waka police matter 3 weeks straight
Native Doctor and Pastor for here dey lick plate
Imagine say the full area no get Big Man
Wetin concern signboard and who dey sell weed? Man
Dry Bread and Sadine plus Igbe Fanta
Naim we dey chop after we don smoke for downtown
I no be mumu Aje
I know the area well
Full Agbasa, Igbudu dem know my matter there
Odumu, Sobo, Ejegba We Get House for Ekpan
Go Udu, Oruvworun
The hands sound
I No Be mumu Aje
I know the area well
Warri Crisis '99 I dey there
Marine Gate, Iyara
We Get House for Ekpan
Go Ogborikoko
Ask na
The hands sound.