🎤 Title: “Mpox Dae”
Verse 1:
Nor turn face, nor act like say yu blind
Mpox dae na di town, e nor dae hard fo find
Pikin dem dey sick, big man dey panic
But we still dey play like say e na trick
E nor be witchcraft, nor be juju
Na real life virus wey dey pass thru
From skin to skin, from hand to face
If you nor take sense, e go lef trace
Chorus:
Mpox dae, we nor go lie
E dae kill slow, e dae make man cry
Tell di youth dem, tell di mammy
Make we wake up, be wise as a family
Verse 2:
Wash yu hand, nor dey share blade
Protect yuself, mek wise trade
Skin lesion? Nor go touch
Go hospital, nor wait too much
Na we health, na we fight
Mpox nor care if na day or night
So mek we talk, nor feel shame
Knowledge na di key, nor play game
Chorus (repeat):
Mpox dae, we nor go lie
E dae kill slow, e dae make man cry
Tell di youth dem, tell di mammy
Make we wake up, be wise as a family
Outro (spoken, heavy tone):
Dis na Kelvin Pusher...
Nor make style.
Na real life we dey talk — protect yuself.
Mpox dae.