(Intro)
Yeah yeah...
Finest the wisest..
Infidag Music Empire...
Listen ya...
(Chorus)
Bra forbody, nor mean say na yu bra,
Some dae smile wit yu, but dae hide bad heart.
Bra forbody, open yu yai,
Nor trust every man way dae call yu "guy".
Bra forbody, shine yu yai,
Na God go show yu who for stand by.
(Verse 1)
Aw dae see plenty fake love na road,
Dem dae call me "bro", but dem heart cold.
Today dem dae clap, tomorrow dem dae hate,
Dem dae wait make yu fall, instead make yu great.
Some boss dae promise say e go make yu star,
After all di sweet tok, yu nor go far.
So me young artist, make una learn,
Respect everybody, but trust nor burn.
(Pre-Chorus)
If man dae love yu, e action go show,
Nor to sweet mouth, na work make e grow.
Keep yu focus, keep yu prayer strong,
One day God go make yu sing victory song.
(Chorus)
Bra forbody, nor mean say na yu bra,
Some dae smile wit yu, but dae hide bad heart.
Bra forbody, open yu yai,
Nor trust every man way dae call yu "guy".
Bra forbody, shine yu yai,
Na God go show yu who for stand by.
(Verse 2)
No jealous, no bad belle, keep clean heart,
Everybody get in own time for start.
If dem lef yu, nor cry nor complain,
God fit use dat pain turn blessing again.
Me message to all di upcoming crew,
Believe na God and believe na you.
Hard work, patience, discipline too,
Success go surely run come to you.
(Bridge)
No sell yu dream for empty promise,
No lose yu way because of fake kindness.
Real brother go push yu go before,
Fake brother go lock every door.
(Final Chorus)
Bra forbody, nor mean say na yu bra,
Some dae smile wit yu, but dae hide bad heart.
Bra forbody, open yu yai,
Keep yu dream alive till the day yu fly.
Bra forbody, na so life be,
God na di only one way nor dae betray we.
(Outro)
IME tok 1
To all young artists...
Open una yai...
Work hard... Pray hard...
God first... Peace.