Yoo, It’s That Boy LØÑÃ — Here We Go Again
(Verse 1)
Gather your funds, make money dey talk,
If I continue like this, my fans fit waka go.
Small small, she don carry belle—omo na shock,
Look my guys, dem don leave me for back, oh no.
But I still dey grind, no time to slack,
Life na marathon, I dey stay on track.
Pressure wan choke but I no go crack,
Dreams for my head, I go turn them to fact.
---
(Verse 2)
Drop that banger, make men still chop,
If nor be VDM, jellof for hard—omo e no soft.
Commot matter joor, I dey stay as a kid,
Chasing the dream wey dem say I no fit reach.
Make money first, make the hustle dey sum,
Before you go burst, before body go cum.
Future dey call me, I no fit play dumb,
This life na beat and I dey play am like drum.
---
(Verse 3)
I get two sis, na only me be boy,
Pressure too much but we dey trust God, no be by noise.
Make you self pray before life go stew,
Grace go locate you, blessings go come through.
My girl Favy just dey make me smile,
She no be my babe but she still worth the pile.
Expensive friend wey dey calm my mind,
Good vibes steady, she rare to find.
---
(Final Verse)
Dem dey tell me say I go regret,
Say last-last the money go flash like cigarette.
But when life dey sweet, you no dey think stress,
You just dey flex, forget say the world fit vex.
All my friends still dey call me Saint,
But behind the name, na silent pain I paint.
I just dey smile, but the smile dey faint—
'Cause sometimes inside that smile, na cry dey wait.
---
HOOK
Here we go again, LØÑÃ on the rise,
Hustle no dey stop, e dey show for my eyes.
Smile for the world but the tears still dey hide,
But I go make am, I go make am, no lie.